Pages

Saturday 17 July 2010

Funny Chat

MESSI AND KAKA'S INTERNET CHAT    

This could crack u up......

Messi:  Bros how far na
KAKA:  I dey o
Messi:  e get as this world cup take be o
KAKA: walahi I no know..
Messi: una own better..Guy na 4-0 dem flog us ,I no score goal,me wey be world footballer!!!
KAKA: Guy dem tear me Red card,I never collect Red before for my life. No be only u no Score, Rooney nko, even Torres.           
Messi: Una lucky say no be Germany una meet. I no even see road dribble.when Gerrard tell me I think say na lie..
KAKA: Eh ya. Kpele. But dat 4-0 too much o. We laff for bus tire as we dey go airport. E sweet us die.
MESSI: make una dress! Una wey no fit head ball?
KAKA: make e be, but dem no disgrace us. last last Holland nor win cup
MESSI: Germany nor win too na. Chei,iniesta nor go let person hear word oh
KAKA: hehe,na una for barca go suffer am na nobody go fit talk for our side as Raul nor go World Cup. Who open mouth,im head go roll
MESSI: Shey... no shaking sha, we go chat later. me wan log out go play Choosing for area so. Heinze dey here sef. E say make I hail u. E dey vex say dem nor choose am for area.
KAKA: make e gerrout. Im too rough sef. hail am sha. E go be. Make I enter church. Dis Mourinho,me no know whether I dey im plan. i dey fasting programme. Later 

No comments:

Post a Comment